"Now dem people come back. W'en dey open de place, dey meet de beef done die.

"Now dey ax de boy, dey say: 'Who kill dis beef heah?'

"Fus' de boy no wan' fo' answer. Now dey begin fo' knock um, dey knock um tay (till) he say he kill de beef.

"Now de man say: 'Yo' mus' surely gie back odder beef fo' dis one wey yo' bin kill.'

"De boy beg so-t-a-y, but de man no 'gree. De boy take he cutlass, he go set trap. Any day he go, but not'ing no ketch. Any day w'en he come, de huntin' man mus' beat um fo' dat beef.

The Dancing Bird.

[[See p. 241.]]

"Now de mammy beg, he beg good fashion, but de man no 'gree fo' lef de palaver, he say de pickin mus' gie um dah beef.

"De mammy say: 'Well, take me pickin one tem (at once), de t'ing yo' wan' fo' do, make yo' do um one tem, make I see.'