"De Watch-pot say: 'How I go do? I no know anybody nah de town 'cept yo'. Make I wait evenin' tem, make we two go togedder.'
"Dey sit down all day. De ress sit down close de fire side.
"De man he call he wef, he tell um, he say: 'Dis man heah no go yeat dis ress.'
"Den leelee pickin dey duh cry, hangry ketch dem. Dey all sit down dey tay (till) young evenin' tem. Well, de man he call he wef nah (from) de room; dem pickin dey cry, he no know how fo' do agin. So he tell he wef, he say: 'I go lay down, I say I sick. W'en he stay leelee bit, I do lek I die. Den make yo' go tell de people in de town say I done die. Bimeby so, jus' de man go', I go grap, (get up) we go yeat de ress.'
"Well, de man he lay down, he say he sick. Leelee bit, no mo', now de daddy he die, but not to true die.
"Well, now de ooman he go tell de man, he say:
"'Daddy, how we go do now? Yo' jus' come tell yo' brudder how do to-day, en look; he done die. Go now, tell de people wey in de town say he done die.'
"De man say: 'Ee, ee! Yo' wey bin ooman, aintee yo' nar ooman, aintee yo' fo' come out wid holler?[66] Go nah de town, tell dem people all. Me, wey man, make me lef close me brudder; lef me fo' mine um tay yo' come.'
"Den de ooman say: 'Well, who go was' um?'
"De man say: 'I go was' um, he now me brudder, I no 'fraid um.'