"Well, w'en dey finis' buil' dis fench wid palm 'roun de ho'se, he tell de chief, say:

"'I wan' one big, big pot; I wan' plenty ress (rice) fo' de Bundo fo' yeat.'[29]

"W'en de chief done gie um all dis, Spider say:

"'I wan' plenty palm-ile, twelve jug[30] palm-ile.'

"Well, w'en de chief done gie um all dis, he ax Spider, say:

"'Wey t'ing yo' wan' agin? Talk, make I gie yo'.'

"Now Spider say: 'I wan' make de fowl gadder one place, make dem go inside de ho'se.'

"De chief say: 'Dis net heah I go sen' word.'

"Befo' de net done fa' down good fashion, w'en de place dark leelee bit, de chief heen (his) messenger walker all 'bout wid dis de chief heen command.[31] He tell de fowl all, make dem mus' gadder mawnin' early, make dem go inside de ho'se wey dey done buil' fo' um, make nobody no lef de town fo' go odder place.