[THE DEVIL TURNS PIGEON]

"One big debble ho'se bin close by one town. Dem debble wey bin deh, dem bad. Dey say: 'Make nobody no fo' set trap inside de bush.' So one 'tranger come to de town. All man tell um say: 'No fo' set trap inside dah bush (forest),' but he deny; he make 'tronger head, he say he mus' set trap deh. So he go make trap. W'en he set dis trap inside de bush, soon one pigeon go inside de trap. Dis bird nar debble wey bin turn bird en go inside de trap. De bird begin cry, he say: 'Daddy, come loose me.'

"So de 'tranger go loose de pigeon, he put um one side. De pigeon cry agin, he say: 'Daddy, kare me go nah ho'se. (De pigeon duh say so).'

"So de man take de pigeon, he kare um go nah ho'se.

"De pigeon cry: 'Daddy, kill me one tem.'

"W'en de man done kill um, he say: 'Daddy, pull de fedder 'pon me.'

"W'en de man done pull de fedder, de pigeon say: 'Clean me.'

"W'en he done clean um, de pigeon say: 'Put pot nah fiah.'