"Wey t'ing yo' no duh yeat fo'?'

"De debble say: 'I done yeat plenty.' But dis girl he (she) no know dis nar debble, oh!

"Well, dis girl heah, he get one brudder wey sick wid craw-craw; craw-craw[45] 'pon heen skin all. Dis boy wan' go tell dis debble 'How do'. W'en he go, dis debble holler 'pon um. De boy 'fraid, he go sit down.

"Well, dis debble wan' pass go home. De girl say he no go lef, he mus' go wid de man. Heen people dey no 'gree make he go yet, but he say he mus' go now, so dey say: 'All ret.'

"Dey gie um all t'ing fo' make um go. Dis same day dey lef de town fo' go home. W'en dey go, dis boy wey (who) sick wan' fo' follow um. He say he mus' follow he sister, but de debble no 'gree, he say because de pickin too waw-waw (ugly).

"So w'en dey go, dah pickin duh follow um leelee (at a distance). Well, dey walker all day. W'en de debble turn, he see dis pickin yeah, he ketch um, he flog um, he say: 'No go follow we!'

"So de pickin go hide behine leelee bit, en de two pusson dey duh go. Soon de debble duck heen han' nah heen pocket,[46] he pull one white kola,[47] he open um; he gie de girl half, hese'f take half.

"De pickin come meet dem agin. W'en de man wan' flog de pickin de ooman say: 'Fren', no flog um, make he follow we.' 'Den de pickin follow leelee, leelee. Well dey walker all day. W'en dey go, dis debble heen one side head come out, fa' down. Well dis girl yeah say: 'Fren', look, yo' head fa' down.'