Which twin restored his father to life?

[[See p. 200.]]

"So de las' boy, de one wey (who) make four, he say: 'I go surely know wey t'ing become of me faddah, I mus' fine um.'

"De odder one say: 'Ef yo' fine um, I kin manage fo' make faddah; ef yo' pick (collect) all de bone I kin join um.' De odder one say 'I kin gie body'; de odder one say: 'I go gie um life.' But dey no tell de mudder w'en dey duh talk 'bout dis t'ing, dey jus' ax um which road den daddy bin take w'en he wan' fo' go hunt. De mammy say: 'Dis back road.'

"Dem four boy dey grap (get up), dey go. Well, dey cut de way t'rough de bush, dey wandah, dey wandah far 'way nah de bush. De las' one he see one leelee road, he hole um wid all heen bruddah, he 'tan' up befo'. W'en dey go, dey go, dey go, dey meet one ribber. Jus' dey reach deh de las' one see heen fadder gun, en he meet heen dry head (skull). Now de odder t'ree boy jus' duh come, en de las' one tell um say: 'I finis' me yown part.'

"Well, de one wey bin say he go join de bone, he dibe bottom de wattah, he meet all dem bone, he bring um all 'pon top de lan', join dem all lek pusson, en he say: 'Look, me finis' me yown part.'

"De odder one he mix mud, he plaster um 'pon all de body, make de hair all. He take palm-leaf, he duck um inside de puttah-put,[52] he fash'n, fash'n um 'pon de mud. De blackness he duh shine, he fine de man. W'en he finis' he tell de odder twin, he say; 'Me done me yown part.'

"De one wey pass all fo' ole (old), he get one leelee horn wey kin protec' de life, kin bring life back. One country-fashion man make de horn, but not fo' dis purpose, he make um w'en de four twin leelee, fo' protec' dem, so nobody no go kill de baby. So dis boy go to de fadder to he nose, he put de horn deh, he blow inside de horn. De fadder sneeze, he grap, he take heen gun, he go home. Heen wef bin cry, he t'ink say somet'ing happen to heen pickin, dey all done die, because since early mornin' dey bin go 'way tay late nah evenin'. Jus' he look he see he man come nah road. De cry turn to laugh, great joy.

"Well, now dem four boy yeah, which one make dem get fadder?"