"Dis bad man he come agin, he tell de king, he say: 'King, yo' bin buy one cow, de cow done multiply, multiply. Ef dey put dem inside place wey dey buil' fo' dem, dey pass one hundred plenty. De boy mus' show de fus' cow wey yo' buy; ef no, he go die.'
"All dis he jus' duh do fo' try kill de boy.
"So de king call he son, he tell um. De boy say: 'All ret, I go come w'en de sun middle de sky; make dem no open de cowfiel'.'
"So de king 'gree. Well, de boy go, he tell de bug-a-bug hill. Well, de bug-a-bug hill see one butterfly, he tell um he mus' do wuk fo' um. So de butterfly tell de boy, he say: 'To-morrow, w'en yo' meet all dem cow form in row, now de cow wey yo' see I fly 'roun' en sit down 'pon, now dis de fus' cow wey de king get.'
"To-morrow de very hour, de boy go. Dem people dey form dem cow, put de fus' cow wey de king buy nah middle dem cow all. W'en de boy 'tan' up, he look de cow fo' moment, he look, he see de butterfly jus' sit down 'pon de cow, he say: 'Ah! Hey! Look de cow middle yandah.'
"All de people wonder fo' see how de boy wise.
"Evenin' tem dis bad man come agin, he no satisfy. He tell de king, he say: 'Make dem dig hole deep, make dem put plenty knef, plenty broke bottle all 'roun' de top, all 'roun' de inside; so so knef, so so broke bottle, down, down. Make dem spread mat 'pon top de hole, jus' cover de hole; make dem set chair deh.'
"De king 'gree. Den sen' de same messenger fo' go call de boy. W'en de boy come, dey say dey wan' talk palaver, make he go sit down to dah chair yandah.
"Well, de boy he go near, he 'tan' up, he tell de king, say:
"'I nebber sit down place excep' I take 'tick, chook de place.'