"De king no know how fo' do, he puzzle. He no lek say no, he no lek say yes, so he 'gree. De boy go take long 'tick, de 'tick he heaby. He beat wid um inside de place, de chair fa' down inside hole. De boy no sit down deh, he go home.

"Now de same bad man he come agin to de king, he tell um say: 'Dis now de las' chance wey kin kill yo' son, he no go get out of dis.'

"So de king say: 'All ret.'

"Dey sen' fo' de boy, he distant 'bout some few mile, he come. Dey spread mat 'pon de groun', dey tell um say dey wan' fo' crown um king. Well, de boy bin come wid one of he servant. Dey tell de boy fo' lie down 'pon de mat, dey go wrap um, tie um so he no able fo' loose hese'f; dey lay heaby, heaby stone 'pon um, dey go hebe (throw) um nah wattah, dey go lef um t'ree day. Dey tell um say, now so dey kin do fo' crown king.

"Well, dis servant wey bin follow de boy, ef he reach 'tranger place, ef he fo'get anyt'ing, w'en he ready fo' go fo' um, all dem people demse'f kin fo'get somet'ing, dey all kin grap (get up) fo' go fine de t'ing. Well, jus' dey done tie he mastah, en dey ready fo' go hebe um nah dis deep wattah, de servant say: 'Oh, I fo'get somet'ing one mile off.'

"Well, all dem people dey grap, (get up) dey all fo'get somet'ing, dey go. De king se'f he grap, he go. Dey all jus' 'tan' lek crazy.

"Well, w'en dey done go, dis boy heah he call one leelee pickin. De pickin come, he loose all de rope, en de boy come out. He put heaby, heaby stone inside de mat, he tie um tight lek wey de people bin tie um. Well, he go, he go 'way home.

"Now de servant he know say he mastah done go, so he come back, en all dem people come. Dey hase (raise) de mat up, dey t'ink say dat de boy inside, dey go hebe um nah de deep.

"T'ree day dey duh hear drum over to de boy he town, dey hear drum en dance. W'en de t'ree day finis', de boy come to de town, he wear crown, he sit down 'pon hoss, plenty people duh follow um; dey too sit down 'pon hoss, dey rejoice. W'en de boy reach to de town wey he fadder bin, he gadder all dem people; he say he wan' fo' come tell dem de t'ing wey he see w'en he die.

"But dem people no know, dey t'ink say nar (it is) true.