"'We go meet nex' moon.'
"Some of dem ooman go back, but some tell den fren', say:
"'Any way wey yo' go nah wuld, we all go go; ef now yo' die, we all go die.'
"Well, w'en dey go far agin, dey reach to one big, big valley. Now all den man dey tell den fren' wey bin say dey go die wid um, dey say:
"'Oonah go back. W'en de nex' moon kin white, we go come agin.'
"So dey all go back. But one no go, he say he mus' follow sotay he reach dah place wey he fren' bin lib. De dog deh wid de ooman. Dah man tell de ooman, he say: 'Go back!'
"De ooman say: 'No!'
"De man say: 'I lek yo' too much, lef nah town. W'en I come back I go come to yo', but no follow me to dah place wey we duh go.'
"Dah ooman say: 'I go go!'